Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 42:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Make una nor fear Babilon king; I dey with una and I go save una from en pawa.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 42:11
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?


Dem go attack yu, but dem nor go fit win yu, bikos I go dey der to save yu. Mi, wey bi God, don tok.”


Di pipol wey I dey send yu go meet, make yu nor fear dem, bikos I go dey with yu and I go save yu. Mi wey bi God, don tok!”


Make una nor fear, bikos I dey with una! I go bring una pipol from east and west kom house back.


Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.


But God dey for my side and E give mi pawa, so dat thru mi, Gentile pipol go hear di Good News and Christ don save mi from lion mout!


Dem dey fear wetin Babilon pipol go do wen dem hear sey Ishmael kill Gedalaya, di govnor wey Babilon king choose. As dem dey go, dem kon stop for Kimham wey dey near Betlehem.


Nor listin to dem! Obey Babilon king and yu go dey save! Why yu wont make dis town turn to where dem go dey trowey dirty put?


Bikos of dem, I go make yu bi like strong wall. Dem go fight yu, but dem nor go fit win. I dey with yu; I go protet and save yu.


So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.


God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.


I dey tok again, so dat yu go dey strong kon get heart! Make yu nor fear or shake, bikos mi wey bi di Oga yor God, I dey with yu for evritin wey yu dey do.”


Nobody go fit stop yu still yu die. I go dey with yu as I dey with Moses. I nor go forget or leave yu.


Bikos di Oga una God dey go with una! E go fight una enemies for una kon make una win di war!”


Make una nor dey sturbon to God and make una nor fear di pipol wey dey di land, bikos dem bi like bread to us. God dey with us and E don defeat di gods wey dey protet dem; so make una nor fear.”


I dey for yor side and nobody go fit do yu anytin, bikos I get plenty pipol for dis town.”


dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”


Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire.


I tell King Zedekaya for Judah di same tin sey, “Make yu honbol yorsef kon respet Babilon king; serve en and en pipol and yu go dey save.


God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.


Den all di pipol, from small go rish di ones wey old kon run komot di town go Egypt, bikos dem dey fear wetin King Nebukadnezzar go do dem.


God dey my side, so I nor go fear. So wetin ordinary pesin fit do mi?


But if any nashon gri kon serve Babilon king, I go make dat nashon stay and chop from en own land. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka