Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 40:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Some among Jew ofisas and dia sojas still hide for di kountry for di hill. Wen dem hear sey Babilon king don make Gedalaya wey bi Ahikam pikin govnor for di land ova di men, wimen, shidren and doz poor pipol wey dem nor karry go Babilon as prisonas,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 40:7
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But e leave some poor pipol kon give dem vineyard and farm, so dat dem go dey work for der.


All di pipol for di land go take dis ofrin go give di prince wey dey rule Israel naw.


Wen King Zedekaya and all en sojas si wetin dey happen, dem kon try to run komot for di town for nite. Dem pass di gate wey join di two wall for back near di king gardin kon go Jordan River Valley.


di enemies break enter di town and all Israel sojas kon dey find where dem go run go. Dem run komot from di town for nite. Dem pass di gate wey dey di two wall for di king gardin, bikos Babilon men dey evriwhere for di town. So dem kon run dey go Jordan River Valley.


But e leave di poor pipol for di land kon give dem field where dem go plant food.


But wen Johanan and di oda soja leaders hear wetin Ishmael do,


Evribody wey Nebuzaradan wey bi di sojas oga leave for Gedalaya kare, dem karry dem go Egypt. Dem still karry mi and Baruk follow body.


But e leave some poor pipol for Judah make dem kare for di vineyards and farms.


Den Nebuzaradan, wey dey kommand di sojas kon karry di pipol wey remain for di town and di ones wey nor strong, go Babilon as prisonas.


kon bring mi kom di palis kourtyard. Dem sey make Gedalaya wey Shafan pikin Ahikam born, kare for mi and make sure sey I rish house well. So I kon stay my house for Judah with di pipol wey remain.


For di sevent mont for dat same year, Ishmael wey Elishama pikin, Netanaya born, wey still bi memba for di royal family and one of di king main offisa kon go meet Gedalaya for Mizpa and e karry ten men follow body. Wen all of dem dey chop togeda,


Den di king dota and all di rest pipol for Mizpa wey Nebuzaradan put for Gedalaya kare, Ishmael kon karry all of dem go Ammon land as prisonas.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka