Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 4:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 God sey, “For dat day, di mind wey kings get, go fail dem! Priests and profets go dey shek with fear.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 4:9
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

“ ‘Una wey dey laf; make una hear, una go sopraiz till una die! Bikos I go do sometin for una time, sometin wey una nor go bilive even if dem tell una.’ ”


Den dem break one part for di town wall rish groun and all di sojas kon run. Since Babilon pipol surround di town, Zedekaya and en men kon wait make nite rish, before dem pass di gate between di two walls wey dey back of di king gardin kon run dey go Jordan River side.


Wetin happen to yor profets wey sey Babilon king nor go attack yu or dis town?


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


For dat time, Egypt pipol go bi like wimen. Dem go shake dey fear bikos Oga God wey dey lead heaven sojas don dey ready to ponish dem.


I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles. Dem go-go meet dia juju for help kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.


My heart dey weak; my body dey dry go like grass and I nor fit chop anytin.


di enemies break enter di town and all Israel sojas kon dey find where dem go run go. Dem run komot from di town for nite. Dem pass di gate wey dey di two wall for di king gardin, bikos Babilon men dey evriwhere for di town. So dem kon run dey go Jordan River Valley.


and dem go seize di town and all en strong building. For dat day, Moab sojas go dey fear like woman wey won born.


Wen God dey Judge una, E go karry una go. E go judge di town both for day and nite. Na fear and pain dis message go give una wen una don undastand am.


So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.


Una wey bi leaders and my pipol shepad, make una shaut kry well-well! Make una mourn and roll for san-san, bikos di time don rish wen dem go kill una kon kut una like goat


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka