Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 4:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 Evribody for di land go run wen dem hear di shariot sound kon si sojas with dia bow and arrow. Some go run go hide for forest; odas go klimb mountin go hide for rocks. Di towns go empty and nobody go remain for der again.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 4:29
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Just like lion wey kom out from where e hide put, na so too di pesin wey dey distroy nashons go kom out. E dey kom distroy Judah: di town go skata finish and nobody go stay der again.”


Den, “dem go tell di mountins, ‘Make yu fall on-top us!’ And tell di hills, ‘Make yu kover us!’


I si God stand near di altar kon sey: “Make yu nak di temple pilas for up, until di foundashon go shake. “Break dem make e fall for di pipol head. I go kill di remainin pipol for war and nobody go fit eskape.


Den dem break one part for di town wall rish groun and all di sojas kon run. Since Babilon pipol surround di town, Zedekaya and en men kon wait make nite rish, before dem pass di gate between di two walls wey dey back of di king gardin kon run dey go Jordan River side.


Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una, den wons una si five of una enemies sojas, all of una go run until una nor many again kon small like poles wey dey on-top mountin or sign flag wey dey on-top hill.”


So God kon allow di oga for Assyria sojas attack Judah. Dem seize Manasseh, hook en nose, tie am with bronze shains kon karry am go Babilon.


Dem attack Israel pipol well-well and Israel sojas kon run go hide for di kaves, holes, inside rocks, pits and wells;


I go send my pipol go far place and nobody go stay for di land again.


Dem karry bow and swod dey kom; dem wiked well-well and dem nor dey sorry for pesin. As dem dey ride dia horse, e bi like sey na nois for sea and dem dey ready to kom fight Jerusalem pipol.’ ”


“But for naw, mi, wey bi God, dey sey: ‘I dey send enemies wey go katch dis pipol like man wey dey katch fish. Afta, I go send oda pipol wey go katch dem like huntas for mountins, hills and holes for rock.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka