Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 4:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Den I sey, “God wey get pawa, wetin make Yu deceive Jerusalem pipol? Yu bin sey peace go dey, but naw, Yu dey ready to kill.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 4:10
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dem deny wetin God tok kon sey, “God nor go do anytin! No bad tin go fit happen to us; wi nor go ever si war or honga till wi die.


I go defend and protet dis town, bikos of my honor and wetin I promise David, my savant.’ ”


Since dem nor gri put God for mind and serve am, E kon leave dem make dem use dia bad mind dey do tins wey dem nor suppose do.


Bikos of dis, God leave dem for dia yeye life. Even di wimen shange and dem kon dey do tins wey nor good.


So God don leave wiked pipol make dem dey do di bad tins wey dia mind, wey bi sey man dey sleep with man and woman dey sleep with woman.


As I still dey tok, Pelataya wey bi Benaya pikin, kon fall die. I fall face groun kon shaut, “God wey get pawa well-well, nor bi so o-o! Yu won kill evribody wey remain for Israel?”


Si yong and old pipol don die for di street. Enemies don kill both boys and girls. Yu don kill dem, bikos Yu dey vex and Yu nor sorry for dem wen Yu dey kut dem.


‘My Oga God! Na Yu kreate heaven and eart with yor mighty pawa and great strent. Nor-tin dey hard for Yu to do!


Pipol wey nor gri listin to wetin God tok, dem dey tell dem sey, ‘Evritin go-go well with una!’ And dem dey tell sturbon pipol sey, ‘Bad tins nor go happen to una at-all!’


Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin. Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’ Even wen dem know sey nor bi so e go bi.


Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin. Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’ Wen dem know sey nor bi so e bi.


Judah, na una kause dis wahala, bikos una dey live yeye life kon dey do bad tins. Na una sin kause dis sofa and e go pain una enter una heart.


So I ansa, “My Oga God, I nor sabi tok well and I still yong too.”


Why Yu make us komot from yor plans and ways? Why Yu make us sturbon like dat, sotey wi turn from Yu? Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu and bikos of di pipol wey bi yor own.


Dem tell di pesin wey dey si vishon sey, “Make yu nor si any vishon for us” and dem tell di profet sey, “Make yu nor tell us di rite tin again!” Dey tell us betta and sweet tins. Make yu just dey lie give us.


Bikos dis time, I nor go only ponish yor savant and pipol, but I go ponish yu too, so dat yu go know sey nobody bi like mi for di whole world.


Moses go back go meet God kon sey, “God! Why Yu kon kause trobol for dis pipol? Wetin make Yu send mi kom?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka