Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 37:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Even if una kill Babilon sojas well-well and na only di men wey una wound remain, dem go still kom burn dis town rish groun.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 37:10
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God vois bi like tonda as E dey lead en sojas wey nobody fit kount. And doz wey dey obey en kommand, many and strong well-well. Di day wey God choose go great well-well, so na who go fit survive am?


So make una listin to di plan wey I get against Babilon town and en pipol. Dem go drag dia shidren go like sheep kon skata dia house.


Only one of una enemies soja go kill 1,000 of una, den wons una si five of una enemies sojas, all of una go run until una nor many again kon small like poles wey dey on-top mountin or sign flag wey dey on-top hill.”


Dem go wound kon fall die for all di street wey dey dia towns.


So make yu listin to di plan wey I get for Edom pipol and wetin I won do to di pipol wey dey Teman town. Dem go drag dia shidren go and I go distroy di land finish bikos of di tins dem do.


But leta, Babilon pipol go kom back kon attack, seize and burn dis town rish groun.


but yu nor get grave, just like bullet wey dem shot trowey. Yor dead body just dey groun with oda pipol wey dem kill with swod; with pipol wey dem won go trow dia dead body for pit.


Anybody wey dem katch, dem go shuk am die and anybody wey dem seize, na swod go kill-am.


Una nor go get anywhere to go dan to knee down with prisonas or to sleep with doz wey dem don kill. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.


Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun. Mi, wey bi God, don tok.”


and burn am rish groun. Dem go burn am with di house where pipol for don make mi vex, bikos dem dey burn incense give Baal juju on-top di house and dey pour wine as ofrin give oda gods.


Dis na wetin happen wen Babilon sojas leave Jerusalem, bikos Egypt sojas dey kom.


God don turn all my strong sojas to fool. As E kommand, many sojas kom distroy my sojas. God mash and press my pipol, just as dem dey press grape.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka