Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 36:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 “Evritin wey I don tell yu about Israel, Judah and all di nashon, make yu go rite dem put for one book. Yu go rite evritin wey I tell yu from di first time wey I tok to yu, afta Josaya just bi king kon rish naw.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 36:2
34 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

tell mi sey: “Make yu rite evritin wey I tell yu put for one book,


“For twenty-three years, from di thirtint year wey Amon pikin, Josaya bi king for Judah kon rish naw, na-im God don dey tok to mi and I nor dey fail to tell una wetin E tok, but una nor gri listin.


So make yu know naw sey, I don give yu pawa ova nashons and kingdoms; to rut and skata; to distroy, ova-take, ribuild and to plant well again.”


Den God tell Moses, “Make yu rite dis tin for groun, so dat pipol go remember am, den tell Joshua sey, mi wey bi Oga God go make sure sey Amalek pipol nor go dey dis world again.”


So I si one hand dey kom meet mi and e hold one book wey dem fold.


Evritin about di distroshon wey go happen to Babilon pipol and some oda tins about Babilon, I rite dem down for book.


As Jehudi read three or four line finish, di king vex, kut dat part for di book komot with knife kon trow am for di fire. Na so e do until e burn di whole book finish.


So I wont make yu go der wen di pipol dey fast again, den read wetin I tell yu sey God tok, wey yu rite for dis book, so dat all of dem go hear am.


God tell mi, “Make yu take one big board kon rite dis tins put, ‘Maher-Shalal-Hash-Baz.’ ” (Wey mean, “Kwik Karry Make Yu Distroy Fast-fast.”)


Den I sey, “Look, I don kom, just as dem rite about mi for yor Book sey:


But na for Ekbatana town for Media aria naim dem for si one book wey get dis rekord:


I rite many-many laws for di pipol, but dem dey rijet dem, bikos dem won follow strenj and yeye god.


For di fourt year wey Josaya pikin, Jehoiakim bi king for Judah, Baruk wey bi Neraya pikin, rite evritin wey I tell am. So I sey,


God sey make I tell di king: “Yu don burn di book kon dey ask Jeremaya, ‘Why yu sey Babilon king go kom distroy dis land, kill evribody and all di animal?’


Naw, Jakob shidren-shidren and Israel family, make una listin to God word.


“Before I put yu for yor mama belle, I don know and choose yu. I don selet yu, before dem even born yu. Yes! I don choose yu as my profet and yu go take my message go evriwhere.”


“Nobody won listin to wetin I dey tok? I swear sey evry word wey I dey tok na true. Make God kom ansa mi. Make dem rite wetin my enemies tok about mi, so dat I go si dem.


Wen Moses rite finish for dia present,


Den I sey, ‘Na mi bi dis, God na wetin yu wont I kom do, just as yor word tok about mi for Moses Law.’ ”


So God stresh en hand kon tosh my mout, den E sey, “Make yu listin, na mi go tell yu wetin yu go tok.


So di ofisas kon send Jehudi wey Shelemaya pikin Netanaya born and na Kushi born Shelemaya. Dem sey make e go tell Baruk make e bring di book wey e from read give di pipol. So Baruk karry di book go meet dem.


Baruk ansa, “Na Jeremaya tell mi evritin wey I rite with ink for dis book.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka