Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 34:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 I go make dia enemies katch and kill dem, den birds and wiked animals go chop dia dead body.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 34:20
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den dis wiked pipol dead body go dey for groun and birds with wild animals go chop am. Nobody go remain for der to porshu di animals.


Na for der I go for skata di plan wey Judah and Jerusalem pipol dey plan. I go make dia enemies win kon kill dem for war and birds with wiked animals go chop dia dead body.


Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.


Den God tell mi about some men from Anatot wey wont make dem kill mi. Dem don treaten mi sey, “Make yu stop to tok about God, if not, wi go kill yu!”


Anybody for yor family wey die for town, na dog go chop am and any one wey die for open field, na vulture go chop am.”


I go give yu to doz wey yu dey fear and wey won kill yu. I go give yu to King Nebukadnezzar for Babilon and en sojas.


Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”


Anybody for yor family wey die for inside town, na dogs go chop en dead body and vulture go chop di ones wey die for di open kountry. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”


Today, God go give yu to mi. I go kill yu for groun kon kut yor head komot. I go give yor dead body to di bird for di sky and di wild animals for di land. Den all di land go know sey Israel pipol get betta God


E tell am, “Kom meet mi, so dat I go give yor flesh to di birds for sky and wild animals for di field, make dem chop.”


I go trow yu for groun make all di birds and animals for di world chop yu finish.


I go trow yu and all di fish inside desert. Yu go die for der and nobody go beri yu. Den I go give yor body to bird and animals make dem chop.


I go make Elam pipol fear dia enemies. Bikos I dey vex, I go distroy Elam pipol kon send sojas go porshu dem until I don kill all of dem finish.


Just as I give Zedekaya for Judah to King Nebukadnezzar for Babilon, na so too I go give King Hofra for Egypt to en enemies.’ ”


So King Zedekaya promise mi for sekret sey, “I swear with God wey dey alive and wey give us life sey, I nor go kill or give yu to di men wey won kill yu.”


Jerusalem pipol, naw wey enemies don distroy and porshu una, wetin una go kom do? Aldo una wear red klot and gold kon paint una eye well, but all doz tins nor mean anytin, bikos di pipol wey una love well-well, don rijet and won kill una.


Una dead body go bi food for di birds for sky and for wiked animal for di eart and nobody go fit porshu dem.


Dem don kill yor savants kon leave dia body for groun make bird chop dem. Doz wey dey fear Yu, dia flesh don turn food for wild animals.


My pipol attack mi like birds or hyenas and oda wiked birds dey with dem. So make all di nashons gada like wiked animals kon distroy dis pipol wey I koll my own.


Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go give yu to pipol wey yu hate well-well.


Dem force Zedekaya make e dey look as dem dey kill all en shidren and en ofisas for Riblah.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka