Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 34:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Di Oga wey bi Israel God sey, “Make yu go tell King Zedekaya for Judah sey, ‘Mi, wey bi God, go give dis town to Babilon king and e go burn am rish groun.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 34:2
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun. Mi, wey bi God, don tok.”


Bikos mi God don sey, I go orda dem and dem go kom di town again. Dem go attack, seize and burn am rish groun. I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.’ ”


King Zedekaya put mi for prison, bikos I tell am sey, “God sey, ‘I go allow Babilon king seize dis town


By dat time, Babilon sojas don burn di royal palis and all di house wey dey Jerusalem rish groun, den dem kon skata di wall.


Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”


Israel God sey, ‘I go distroy yor sojas wey dey fight against Babilon king and en sojas. I go bring dia sojas kom di town centre.


For di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon go fight Jerusalem. E build kamp round di town.


Dem go karry dem go Babilon until di day wey I go remember dem. Den, I go bring una kom back kon give una evritin wey una don lost for dis place. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”


E burn God Temple, di royal palis and all di house for Jerusalem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka