Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 33:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 “Koll mi wen yu dey pray and I go ansa yu; I go tell yu great and wonderful tins wey yu nor know about.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 33:3
29 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den una go koll my name kon pray give mi and I go ansa una.


Even before dem go pray to mi, I go ansa dia prayers and as dem still dey tok, I go hear dem.


So, make all di glory bi God own; di Pesin wey dey do pass di tins wey wi go fit ask or tink, thru en pawa wey dey work inside us.


Una don hear and si evritin wey I tok sey go happen. Una go fit deny sey I nor tell una before? From naw go, I go tell una new tins wey go happen, wey una neva hear or know about before.


Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem.


But if una turn to God from der, E go kom help una, dat na if una really turn kom meet am with all una heart and soul.


Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una, den una go give mi all di glory.”


God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind.


In-short, e nor get any oda kountry wey dia gods dey klose to dem like di Oga awa God wey dey ansa wen ever wi koll am.


For dat time, evribody wey koll God name, God go save am.” ’


Before God wey get pawa do anytin, E go first show en plans to di profets, wey bi en savant.


God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant.


I go give yu betta tins wey dem hide for dark and sekret place. Den yu go know sey, na mi bi God! Israel pipol God, wey koll yor name.


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go gi-am some manna wey dem hide for heaven. I go gi-am white stone and for dat stone, dem go rite new name put and nobody go fit undastand am, escept di pesin wey I give di stone.’ ”


E do am so dat wetin di profet tok, go happen: “I go open my mout tok parabol, I go tok evritin wey bi sekret since God kreate dis world.”


God sey, “Yes! I go do big mirakle among una; di kind ones wey I do wen I save una from Egypt where una for bi slaves.”


And evribody wey koll God name, go dey save; bikos on-top Mount Zion, God go diliver pipol just as E tok. Dem go survive with doz wey God don koll.


To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.


So mi, Jeremaya dey tell una sey, “Make una dey ask una friend or relashon, ‘Wish ansa God give and wetin God tok?’


‘My Oga God! Na Yu kreate heaven and eart with yor mighty pawa and great strent. Nor-tin dey hard for Yu to do!


‘Na mi bi di Oga wey bi evribody God. Nor-tin too hard for mi to do.


E kon ask dem to pray to God wey dey heaven make E for sorry for dem kon show dem di dream and en meaning, so dat en and en friends nor go die with di oda-wise men for Babilon.


All di sekret tins wey dem hide, E dey bring am out; E know wetin dem hide for darkness and na lite E take kover ensef.


I praiz and honor Yu, di Oga wey bi my papa dem God. Yu don give mi wisdom and pawa; Yu don ansa my prayers kon show mi wetin I go tell di king.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka