Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 33:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Shepad go kount dia sheep again for all di towns wey dey di hill kountry; di valley; Judah sout; Benjamin land; di village wey round Jerusalem and all di town for Judah. Mi, wey bi God, don tok.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 33:13
9 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

One out of evry ten animal wey dey stay house, go bi God own. Wen dem don kount di animals finish, di tent one go bi God own.


“If yu get hundred sheep and one lost, yu nor go leave di ninty-nine wey remain go find dat one till yu si am?


Den pipol go kom from Judah town and from all di village wey dey round Jerusalem; from Benjamin town go rish di hill, mountins and from sout for Judah. Dem go bring burnt ofrin, sakrifice, korn ofrin, incense and tanksgivin ofrin kom my temple.


Bikos of di gift wey God give dem wey bi; korn, wine, olive oil, sheep and melu, dem go gada kom sing with happiness for Mount Zion. Dem go bi like gardin wey dem pour wota put well-well kon get evritin wey dem wont.


Israel God sey, “Pipol go buy many house, field and vineyard for dis land, again.” ’


Pipol go buy dia land and dem go sign di agriment, gum-am and pipol go witness am. Dis tins go happen for Benjamin land; di village wey dey round Jerusalem; all Judah town and for di towns wey dey di kountries for hill with all di land under di hill for Judah sout. I go bring di pipol kom back to dia land. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”


Na mi, God dey kontrol una, so dat una go obey my kommand.


Doz wey dem katch for Israel before, go kom back kon stay for Foenicia wotaside wey dey nort for Zarefat. Jerusalem pipol wey dem katch and karry go nort go kom back to dia house for Negev.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka