Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 33:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 God wey mighty sey, “Dis land wey bi like desert where pipol or animals nor dey stay, I go turn am to where fresh green leaf go dey and shepad go take dia sheep go chop for der.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 33:12
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dem go woship mi kon lead dia sheep and melu go chop grass for Sharon and for Akor Valley for east.


Den make yu pray sey, ‘Oga God! Yu don sey Yu go distroy dis place and pipol or animals nor go stay der again and e go dey empty forever.’


God sey make I tell di king: “Yu don burn di book kon dey ask Jeremaya, ‘Why yu sey Babilon king go kom distroy dis land, kill evribody and all di animal?’


Pipol go stay for Judah and all en towns; farmers go dey evriwhere and shepad go dey to guide dia animals.


Den pipol go kom from Judah town and from all di village wey dey round Jerusalem; from Benjamin town go rish di hill, mountins and from sout for Judah. Dem go bring burnt ofrin, sakrifice, korn ofrin, incense and tanksgivin ofrin kom my temple.


My love, make yu tell mi! Na where yu won go feed yor animals today? Where yor sheep dem go for rest dis aftanoon? Make yu tell mi, if not I go dey waka up-and-down like ashawo for where yor friends and dia animals dey!


Bikos of di gift wey God give dem wey bi; korn, wine, olive oil, sheep and melu, dem go gada kom sing with happiness for Mount Zion. Dem go bi like gardin wey dem pour wota put well-well kon get evritin wey dem wont.


Israel God sey, “Pipol go buy many house, field and vineyard for dis land, again.” ’


My pipol bi like sheep wey waka lost. Who dey guide dem don make dem lost. Dem dey waka anyhow for di mountins; dey from one hill go anoda. Dem don forget dia place where rest dey.


“My pipol, e good as una dey stay for fine-fine house and my temple skata?”


Dis land wey bi like wildaness before, evribody go si and tok how e don turn and fine like Eden Gardin and how di town wey skata rish groun before, don fine and get pipol again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka