Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 33:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 God sey, “Una dey sey, ‘Dis place bi like desert, bikos pipol or animals nor dey stay inside again.’ Una korrect; bikos Judah town and all di street for Jerusalem go dey empty; pipol or animal nor go stay der, but una go hear pipol dey shaut dey happy for dis place again.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 33:10
9 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Una dey sey di land go bi like desert where pipol or animals nor go dey again. Dem still sey dem go give di land to Babilon pipol. But my pipol go buy field for dis land again.


God kon tell mi, “Man pikin, Israel pipol bi like dis bones. Dem sey dem don dry finish, dem nor get hope or bilive sey dia future dey brite.


“ ‘Jeremaya! Yu and di pipol korrect wen una sey war, honga and diziz go make dis town fall and Babilon king go seize am. Naw, make yu listin to wetin I get to tok about dis town:


I go distroy una land finish and una enemies wey dey stay der before, go shok for di kind distroshon.


Wetin make yu dey tok all dis foolish tins with God name? Wetin make yu dey tok with en name sey, ‘Dem go distroy dis temple, just as dem distroy Shiloh and nobody go dey here again.’ ” Den all di pipol kon gada round mi.


Bikos mi God don sey, I go orda dem and dem go kom di town again. Dem go attack, seize and burn am rish groun. I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.’ ”


“My pipol, e good as una dey stay for fine-fine house and my temple skata?”


My God, make Yu show us yor loyal love! Pour yor salvashon for awa head!


Bikos E don make di iron for una gate strong kon bless all una shidren.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka