1 Wen I still dey prison for di kourtyard, God tok to mi again.
So I dey di palis kourtyard, until di day wey dem attack and karry Jerusalem pipol go Babilon.
So, King Zedekaya kon sey make dem lock mi for di kourtyard wey dey di palis. I stay for der and evriday, dem dey give mi bread chop, until all di bread for di town finish.
So, Hanamel kom meet mi for di kourtyard sey make I buy en field, just as God tok. Den, I kon know sey, God really tok to mi.
and na dis Good News make mi dey sofa, sotey dem kon put mi for prison like tif; but dem nor fit put God word for prison!
Den I tell Baruk, “Dem sey make I nor enter di temple again.