Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 32:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 Dem even go put dia yeye juju for di temple wey dem build to woship mi and naw, dem don make am dirty.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 32:34
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God sey, “I don rijet Judah pipol, bikos of di wiked tins wey dem do. Dia juju wey I hate, dem put am for my temple kon make di temple dirty.


God sey, “Di profets and priests nor know mi; I katch dem dey do wiked tins for my temple.


E remove all di juju and image dem from God Temple. All di altars wey e build for di hill for God Temple and for Jerusalem, e trowey dem.


E remove Asherah juju pole from God Temple kon burn am outside Jerusalem for Kidron Valley. E burn am to ashes kon trow am put for where dem for dey beri pipol.


Manasseh na twelf years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for fifty-five years. En mama name na Hepzibah.


Wen una don do all dis tins wey I hate finish, una go kom stand for my present inside my temple kon dey sey, ‘Wi dey save!’ Una tink sey una really dey save wen una dey do all di tins wey I hate?


I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.


Una bin shange kon dey do wetin I wont. All of una gri to free una slave and una enter kovenant for my present; for di temple where dem for dey woship mi.


I dey send my savants and di profets kom meet dem, so dat dem go stop all dis wiked tins wey I hate,


All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.


And dem even build where dem go for dey woship for Tofet wey dey Ben-Hinnom Valley, so dat dem go fit sakrifice dia shidren give juju for der. Dis na wetin I sey make dem nor do! True-true, dat kind tin neva even enter my mind to tell dem.


Doz wey love una, don forget una; dem nor kare about una again, bikos I don attack una like una enemy. Una ponishment go sirious well-well, bikos una wiked and don sin well-well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka