Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 32:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 So, mi wey bi God sey, “I go give dis town to King Nebukadnezzar for Babilon and en sojas and dem go seize

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 32:28
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

King Zedekaya put mi for prison, bikos I tell am sey, “God sey, ‘I go allow Babilon king seize dis town


“ ‘Jeremaya! Yu and di pipol korrect wen una sey war, honga and diziz go make dis town fall and Babilon king go seize am. Naw, make yu listin to wetin I get to tok about dis town:


Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.


I go still make dia enemies tif dia propaty kon seize all di betta-betta tins. Dem go karry Judah king propaty go Babilon.


E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.


Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon.


Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun. Mi, wey bi God, don tok.”


Di Oga wey bi Israel God sey, “Make yu go tell King Zedekaya for Judah sey, ‘Mi, wey bi God, go give dis town to Babilon king and e go burn am rish groun.


Yu nor go fit eskape and dem go katch yu give di king. Yu go si and tok to am one-on-one, den dem go take yu go Babilon.


But mi God go bring wahala kom di town; dem go mourn and kry and e go bi like my altar where dem for dey do sakrifice.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka