Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 31:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 I go build una again and una go take una sheke-sheke kon dance and dey happy again.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 31:4
31 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go make Israel and Judah pipol prosper and I go build dem as dem bi before.


Den di yong wimen go sing with joy, while di yong and old men, go dey happy. I go konfort dem kon turn dia kry to joy and dia sorrow go bi happiness.


“Israel town wey ‘neva sin wons’ don fall and e nor go fit raiz again! E just dey groun like dat and nobody gri help am.”


“ ‘Afta all dis tins, I go kom back and I go build David house wey don fall; I go build am with all di san wey skata for groun and e go strong again,


Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,


Den, make una go take di melu wey fat pass, kill-am make wi do party,


Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?


And dis na wetin I tok about am: “ ‘ “Zion dota wey neva sleep with anybody before, dey curse and laf yu; Jerusalem dota dey shake head follow yu.


God don turn all my strong sojas to fool. As E kommand, many sojas kom distroy my sojas. God mash and press my pipol, just as dem dey press grape.


So make una mark di road, so dat una go know where una pass wen dem dey karry una go Babilon. Israel pipol, make una kom back to di town wey una run leave.


God still sey, “Ask di oda nashon if dis kind tin don ever happen before. Israel pipol for bi like woman wey neva ever sleep with man wons, but dem don really do wiked tins.


So make yu know naw sey, I don give yu pawa ova nashons and kingdoms; to rut and skata; to distroy, ova-take, ribuild and to plant well again.”


Bikos God go diliver Zion kon ribuild Judah town and en pipol go stay der again kon take-ova Zion.


My God, make Yu look Zion with favor kon help am; make Yu ribuild Jerusalem walls again.


Wen Jeftah rish en house for Mizpa, en only pikin wey e get for en life, run kom out kon meet am, dey dance and play tamborin with happiness.


God sey, “For dat day, I go ribuild David kingdom wey fall. I go ripair en fence kon build am back. I go build am again kon make am bi as e bi before.


God sey make I tell di pipol dis word: “I dey kry both day and nite and nor-tin fit stop mi, bikos my pipol don wound and dia sore deep well-well.


“God sey, ‘Jerusalem town dey laf and play with King Sennakerib.


Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,


Evry blow wey E give dem, Israel pipol go support am with music from dia trumpet and jita and E go attack dem with en swod.


I go kare for dem kon bring dem kom back to dis land. I go karry dem up and nor-tin go fit bring dem down. I go plant dem and nor-tin go fit rut dem.


God sey, “Di time dey kom wen dem go ribuild evriwhere for Jerusalem wey bi my town; from Hananel Towa for west go rish Korna Gate.


Egypt pipol! Make una go Gilead go find medicine, but all una medicine nor go work and nor-tin go fit heal una.


Oga God go pity en pipol, Israel. E go choose dem as en own kon let dem stay di land again and strenjas go kon stay der with dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka