Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 31:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 Dis na wetin Oga God tok: “Just as nobody go fit measure di heavens or open di eart foundashon, na so too I nor go ever rijet Israel pipol bikos of wetin dem do. Mi, wey bi God, don tok!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 31:37
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E get anybody wey fit pak wota for hand kon measure am? Abi who fit measure di sky? Abi anybody don fit weigh all di san for di eart or weigh di mountins and hills with skale?


I go make my savant, David shidren-shidren and all di priest from Levi tribe plenty, so dat dem nor go fit kount dem, just as dem nor fit kount star for sky or san-san for wotaside.”


I go kom meet and save una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una. I go must ponish una, but I go do am to korrect una. Mi, wey bi God, don tok.”


Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!


Yor love wey nor dey fail go last forever. Yor goodness dey forever like di heavens.


I go save and dey with una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una finish. I go ponish una, but I go do am small-small. Yes! I nor go let una go without ponishment. Mi, wey bi God, don tok.”


I go bless Israel pipol wey kom from Judah tribe and na dia shidren-shidren go stay my land. My pipol wey I choose wey serve mi, na dem go stay for der.


Yu know how di world big rish? Ansa mi, if yu know!


“I promise una for Noah time sey I nor go use wota distroy di world again. Naw, I dey promise sey I nor go vex for una again and I nor go rebuke or ponish una again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka