Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 31:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Instead, di pesin wey chop grape wey nor ripe, na en own tit go dey pain am and e go die bikos of en own sin.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 31:30
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na di pesin wey sin, go die. Pikin nor go sofa, bikos of en papa sin and papa nor go sofa, bikos of en pikin sin. Pesin wey good, God go pay am for en goodness, but wiked pesin go sofa di wikedness wey e do.


But evil pipol own don finish, bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.


Bikos each pesin go karry en own load by ensef.


Na mi get evribody life, even una papa and mama plus dia shidren life, na mi get am. Di pesin wey sin, na-im go die.


Make una nor kill papa or mama, bikos of di sin wey dia shidren kommit, or kill shidren bikos of wetin dia papa and mama do; if una go kill pesin at-all, e must bi for en own sin.


Wen pesin wey good for God eye stop to do good kon dey do bad tins, e go die bikos of di bad tins wey e dey do.


Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat.


I fit promise good man good life, but if e bigin tink sey di good wey e do before go save am, den e start to sin, I nor go remember all di good wey e do. E go die, bikos of en sins.


If I sey wiked pesin go die and yu nor warn am to shange, so dat e go save en life, den e kon die as sina, I go whole yu for en deat.


and God Spirit enter my body kon raiz mi up. Den God tell mi, “Make yu go lock yorsef inside yor house.


But e nor kill di savant shidren. E obey God kommand, just as dem rite for Moses Law sey, “Make una nor kill papa, bikos of wetin dia pikin do and make una nor kill pikin, bikos of wetin dia papa do. If una must kill anybody, make e bi for en own sin.”


Make who sin karry di trobol by ensef; make dem feel God vexnashon.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka