29 “Wen dat time rish, pipol nor go sey, ‘Papa and mama chop grape wey nor ripe, but na dia shidren tit dey pain dem.’
Na awa grand-grand papa dem sin and dem don die, but naw, wi dey sofa dia ponishment.
Instead, di pesin wey chop grape wey nor ripe, na en own tit go dey pain am and e go die bikos of en own sin.”
Make una nor kill papa or mama, bikos of di sin wey dia shidren kommit, or kill shidren bikos of wetin dia papa and mama do; if una go kill pesin at-all, e must bi for en own sin.
Yu dey sey, ‘God go ponish pikin for di sin wey en papa kommit!’ No! But make God ponish di pesin wey sin, so dat e go know wetin e do!