Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 31:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 God sey, “Di time dey kom wen I go make pipol and animals full Israel and Judah land again.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 31:27
8 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go make my pipol stay for di land and dem go prosper. Doz wey dem dey koll “No-pity” before, I go pity for dem and doz wey dem dey koll “Nor bi my pipol,” I go sey, “Naw, una don bi my pipol”, den dem go ansa sey, “Na Yu bi awa God.”


I go make una pipol and animals dey plenty evriday. Una go many pass as una bi before and una shidren go plenty. I go let una stay here as una dey before kon make una betta pass before. Den una go know sey na mi bi God.


I dey una side; I go make sure sey una land dey good and una go fit plant put again.


Even doh I skata dem go oda nashons, dem go remember mi for anywhere wey dem dey. Dem with dia shidren wey survive, go kom back to Israel land.


Di pipol wey dey stay der go sing, praiz and dem go shaut for joy. My blessing go make dem many well-well and e go bring honor for dem.


For all di work wey una go do with una hand, God go make una prosper. Una and una animals go get plenty pikin and una plant go produce plenty food. Bikos God go dey happy to make una prosper, just as E dey happy wen una grand-grand papa dey prosper.


I go make una many. Una go stay for di town and evritin wey don skata before, una go ribuild dem back.


Yet E save poor pipol from doz wey dey opress dem kon make dia family many like plenty animals.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka