Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 30:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Dia shidren-shidren go bi as dem bi before and dem go always dey my present, den I go ponish di pipol wey bin dey opress dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 30:20
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Di only tin wey I go let dem do for dis life: na to always dey honor mi, bikos na for dem and dia shidren-shidren good.


Dat time, Israel pipol dey holy to di Oga God; na dem bi di first fruit wey E plok and evribody wey won attack Israel, God dey ponish and distroy dem.” ’ ”


di Oga wey bi una God dey defend una naw sey, “I dey take di cup wey I give una with vexnashon. Una nor go drink di wine wey dey make una stagga again.


I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”


Yor savant shidren-shidren go always dey save. Dia shidren-shidren go always dey save for yor present.”


So, make una rite dis tin down for una shidren-shidren, so dat wen dem born dem, dem go praiz God.


But naw, doz wey distroy una, dem go distroy dem too and dem go karry all una enemies go Babilon as prisonas. Dem go opress doz wey dey opress una and doz wey tif from una, dem go tif from dem too.


Na raitiousness go make una strong. Una go dey save from pipol wey dey opress una and from doz wey dey kause wahala.


Boys and girls go full di strits kon dey play again.”


I go koll and gada my pipol togeda. I go save dem and dem go many pass as dem bi before.


My Oga God, make Yu save and take us back as yor own! Make Yu give us di happiness wey wi get before.


“I go make Judah pipol strong and I go save Israel pipol. I go sorry for dem kon bring dem back to dia land. Dem go bi like pipol wey I neva rijet before. Na mi bi Oga dia God and I go ansa all dia prayers.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka