Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 30:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 God tell en pipol, “Dem nor go fit cure una wound and una sore go dey forever.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 30:12
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So, wetin make mi still dey sofa? Why I go dey bear dia curse like sore wey nor get cure? Yu dey plan to leave mi like stream wey dry?”


Make una nor komplain about una sore again, bikos e nor get cure. I dey ponish una like dis, bikos una wikedness and sin, too mush.


God sey make I tell di pipol dis word: “I dey kry both day and nite and nor-tin fit stop mi, bikos my pipol don wound and dia sore deep well-well.


But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex.


God kon tell mi, “Man pikin, Israel pipol bi like dis bones. Dem sey dem don dry finish, dem nor get hope or bilive sey dia future dey brite.


Just as well dey bring fresh wota kom out, na so too Jerusalem dey bring all en wikedness kom out. I dey hear war and distroshon nois for di town kon si wound and sickness for evriwhere.


Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?


Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.


bikos my pipol sore too deep and e don even rish Judah too. Yes! E don rish Jerusalem gate.


Yor sore nor get cure and nobody go fit heal yu again. Doz wey hear as dem take distroy yu, dey klap and sing with joy, bikos yor wahala and trobol, too mush.


Medicine nor dey Gilead again? Doctors don finish for here? If dem dey, wetin make dem neva cure my pipol?


Den I sey, “My God, Yu don forget Judah pipol? Na so Yu hate Zion town? Wetin make Yu dey do us like dis, sotey wi nor dey okay again? Wi dey hope for peace, but na wahala wi dey si. Wi dey bilive sey wi go well, instead na trobol dey follow us.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka