Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 29:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Make una work well-well for di town wey I send una go as prisonas and make una pray make I bless dem, bikos if dem prosper, una go prosper too.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 29:7
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Una must give dem dis tins, so dat dem go fit offa sakrifice wey God wey dey heaven go asept and pray make E bless mi and my sons.


So, my king! Make yu follow my advise. Make yu turn from sin kom meet God; dey do good and sorry for poor pipol. Den yu go kontinue to prosper.”


Yu must do evritin wey God for heaven wont for en temple kon make sure sey, E nor ever vex for mi and doz wey go rule afta mi.


Make evribody obey di pipol wey dey rule dem. Bikos na only God dey give authority and put pipol for pawa.


Den Daniel (wey en name na Belteshazzar) kon dey worry sotey e nor fit tok anytin. Di king kon tell am, “Belteshazzar, make yu nor let dis dream and en meaning worry yor mind.” Daniel ansa, “My king, e for betta sey dis dream na for yor enemy and wetin e mean, na for di pipol wey dey trobol yu!


But una must obey di rulers, bikos una know sey naim bi di rite tin to do, nor bi bikos God go vex for una.


So make una pray for peace for Jerusalem and evribody wey love am, go prosper.


Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”


“Naw, make yu tell doz wey dey with yu wetin I dey tok so. Na mi send dem go stay for strenj land kon skata dem for evriwhere. Yes, I go still dey with dem for di land wey dem dey.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka