6 Make una marry kon born shidren. Make una shidren marry kon born shidren too, so dat una go plenty for di land.
E get thirty sons and thirty dotas. E make en girls shidren marry men from outside en town and en boys shidren marry dia wife from anoda town too. Ibzan rule Israel pipol for seven years.
Laban ansa, “E betta make I gi-am to yu dan any oda man. Make yu stay with mi.”
Na Rebekah stand so for yor front. Make yu take am dey go, so dat e go bi yor oga Abraham pikin wife, just as God don tok am.”
E stay for Paran wildaness. En mama go Egypt go bring wife kom for am.
So I wont make di yong wimen marry; born shidren; dey guide dia house, so dat enemies nor go get shance to akuiz dem.
Wen e go house back, e kon tell en papa and mama, “I si one Filistia girl for Timnah wey I like, make una bring am for mi, bikos I won marry am.”
So Shekem tell en papa Hamor sey, “Make yu help mi get dis girl make e bi my wife.”
But yu go get many shidren and dem go many kon full di whole eart.”
Dem bless Rebekah kon sey: “Awa sista, yu go bi mama to tazon-tazon pipol! Yor shidren-shidren pawa go strong pass dia enemies own.”
But na only una go-go find dem and di block wey una go make must bi di same as before.’ ”