4 “Israel God wey dey mighty dey tell di pipol wey Babilon king karry from Jerusalem go as prisona sey:
“Mi, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Di pipol wey dem karry go Babilon bi like dis good fig and I go trit dem well with kindness.
Pipol nor dey fear, if dem blow war trumpet for di town? Abi wahala dey just happen for town, wen God nor allow am?
Na mi kreate both lite and darkness; di Pesin wey dey bring blessing and wahala and na mi wey bi God, dey do all dis tins.
Naw, make I tell una wetin I go do to my vineyard: I go remove di fence wey dey round am kon break di wall wey dey protet am. I go let animals chop and mash am anyhow.
‘Make una build house kon setol down, den plant seeds and chop anytin wey e produce.