Dem go karry dem go Babilon until di day wey I go remember dem. Den, I go bring una kom back kon give una evritin wey una don lost for dis place. Mi, wey bi God, don tok.” ’ ”
‘Si, evritin for yor palis, plus all di tins wey yor grand-grand papa dem don gada rish today, dem go pak all of dem one day karry go Babilon; nor-tin go remain.’ God still sey,
Di king karry all di tins wey dey God Temple go Babilon; weda di tins big or small, plus all di tins wey dem keep for God Temple, Israel kings and en ofisas store room.
Dem don tif all wetin e get; all en betta tins don vanish. E dey look as strenjas dey use di holy temple anyhow; di place wey God sey make dem nor enter.