Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 26:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 And wen King Jehoiakim, en sojas and ofisas hear wetin Uriaya tok, e kon try to kill-am, but Uriaya hear kon run go hide for Egypt, bikos e dey fear.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 26:21
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Anytime dem sofa una for one town bikos of mi, make una run go anoda town. I tell una true word, una nor go run pass all di town for Israel, before Man Pikin go kom back.


Herod kon get mind to kill John, but e dey fear di pipol, bikos dem bilive sey, John na profet.


Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.


Asa vex well-well for di profet, so e kon put am for prison. Dat time, King Asa still vex opress some pipol.


So Herodias kon get bad belle for John and e won kill-am, but e nor fit.


Pesin wey hold en life tait, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am.”


Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire.


E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save.


Even doh my life nor balance at-all, I nor go stop to obey yor kommandment.


Dem plan kon stone Zekaraya die for God kourtyard.


Wen di leaders hear wetin happen, dem rush kom di temple from di royal palis. Dem kon form one kourt for where di New Gate for God temple dey.


Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”


As long as yor Oga my God dey alive, I dey tell yu sey, my oga don send pipol go evriwhere go find yu. Wen dem tell am sey, ‘Yu nor dey der,’ e go make sure sey dem swear sey dem nor really si yu.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka