Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 26:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 “Wen Hezekaya bi king for Judah, Profet Mikah from Moreshet profesai give di pipol. E tell dem sey, ‘God sey, “ ‘ “Dem go klear Zion like field; Jerusalem go turn where dem dey trowey dirty put and di temple hill go turn forest.” ’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 26:18
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

And naw, Oga God sey, “I dey go back to Jerusalem kon stay for Zion wey bi my holy town. Den pipol go koll Jerusalem ‘Di town wey dey faithful’ and dem go koll Oga God mountin, ‘Di holy mountin.’ ”


Dis na di message wey God give Mikah wey kom for Moreshet town about Samaria and Jerusalem, for di time wen King Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah.


For en friends and Samaria pipol front, e kon sey, “Wetin dis yeye Jew pipol tink sey dem dey do? Dem one build di town again? Dem tink sey, na to offa sakrifice dem go take build di town finish one day? Dem go fit make stones from di ashes of di tins wey fire burn?”


So, bikos of una, I go klear Zion like field; Jerusalem go bi where dem dey trowey dirty put and di temple go turn hill wey grass grow kover.


and for di mountin wey dey di open kountry. Bikos of di sins wey una don kommit for di land, I go make una enemies karry una propaty and di tins wey una like well-well.


God sey, “I go pak dirty full Jerusalem and jackals go dey stay der, den I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.”


My God, strenjas don take di land wey Yu choose as yor own. Dem don spoil yor holy temple kon turn Jerusalem to where dem dey pour dirty put.


Babilon go turn where dem dey trowey dirty put and trobol go dey follow am. Pipol go fear and hate dem and nobody go stay der again.


Dem nor tell yu sey na mi plan all dis tins before dem happen? I don do as I plan dem. Na mi give yu pawa to turn towns wey dem guide well-well, to where dem dey trowey dirty put.


King Hezekaya and Jerusalem pipol kon turn kom meet God and E forgive dem again.


For di last days, di mountin where God temple dey, na-im go high pass all di mountins. E go high pass di hills too and pipol from evry nashon go dey rush go der go woship God.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka