Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 25:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Di nois go loud rish evriwhere for di eart. Bikos God get wetin E one tok against di nashon. E go judge evribody kon kill wiked pipol. Mi, wey bi God, don tok.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 25:31
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Israel pipol, make una hear wetin God dey tok! God dey akuiz evribody for Israel sey: “For dis land, nobody love mi, dey faithful or si mi as en God.


I go gada and judge di pipol for Jehoshafat Valley, bikos of wetin dem do my pipol. Dem skata Israel pipol for evriwhere kon divide dia land.


Naw, make di mountins listin to God! E get kase against en pipol. E go tok wetin Israel pipol do.


Wiked and bad pipol wey dey di world, E go ponish dem with fire and swod kon kill dem well-well.


Naw, God get wetin E go tok against Judah pipol. E go ponish Jakob shidren bikos of di way dem dey bihave. E go pay dem back for wetin dem don do.


God don plan di day wey E go revensh Edom pipol for all di bad tins wey dem do en pipol, Israel.


I go ponish am with diziz and en pipol go dey kill each oda anyhow. Heavy rain, big-big stones, fire and sulfur go fall on-top en and en sojas; plus all di oda kountries wey dey en side.


Yu dey find betta tins for yorsef? Make yu nor worry yorsef, bikos I won bring wahala kom dis world. But anywhere wey yu won go, I go let yu go and I go save yu.’ ”


Wen Yu fight for us, nashons dey run! Wen dem hear yor nois, dem dey run skata.


una still sey, ‘Wi neva do any bad tin at-all, so God nor go vex for us again.’ But make una look! I go make sure sey I judge una, bikos una sey, ‘Una neva kommit any sin.’


God dey vex for all di nashons and dia sojas. E go kill and distroy dem.


But just look, God vexnashon go kom like heavy breeze and e go blow wiked pipol head komot.


Di day wen God go take akshon, don near. For dat day, darkness and trobol go full di kountry.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka