Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”
God still sey, “Even doz wey I nor suppose ponish, go drink from di ponishment cup. Abi una bin tink sey I nor go ponish una? No! Una must drink from dat cup!
But if oda nashon or kingdom nor gri serve or respet King Nebukadnezzar for Babilon, I go ponish dat nashon with war, honga, diziz and I go distroy am.
Just as una swallow my pipol for my holy mountin, na so too una and di oda nashons go swallow di ponishment wey I go give una. Una go drink kon stagga until una disappear komot from dis eart.