Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 24:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Afta King Nebukadnezzar for Babilon don karry Jehoiakim pikin Jekonaya, wey bi King for Judah, en ofisas and all di pipol wey get handwork go Babilon, God kon show mi two basket wey fig fruit full for di temple front.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 24:1
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I rite am afta dem don karry King Jehoiashin, en mama, di ofisas for di palis, Judah and Jerusalem leaders and doz wey know work well-well, go Babilon.


Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.


For anoda vishon; I si Joshua wey bi di High Priest stand for God angel front; Satan too stand for Joshua rite hand side and e dey akuiz am.


Den God kon show mi four men wey bi karpenter.


I kon si anoda vishon. For dis vishon, I si God stand near one wall wey dem measure well before dem build am and di ruler dey en hand.


God kon show mi anoda strong vishon. For dis vishon, I si as E dey ready to ponish en pipol with fire. Di fire burn di big sea, den e kon start to burn di land.


Dis na wetin Oga God show mi for vishon: I si as E dey prepare many lokust to kom attack all di plant for di land. Dis tin happen afta dem don harvest di king share and di remainin plant dey grow kom out.


Before God wey get pawa do anytin, E go first show en plans to di profets, wey bi en savant.


Den dem put am for kage kon karry am go give Babilon king. Dem put am for prison, so dat pipol nor go hear en vois again on-top Israel mountin.


For dat time, di offisa oga for King Nebukadnezzar for Babilon kon go fight and seize Jerusalem.


Dis na di message wey God give Isaya wey bi Amos pikin about Babilon.


wen Nebukadnezzar, Babilon king kon karry Judah King, Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and en ofisas for Judah and Jerusalem, go Babilon as slave.


Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and all Judah pipol wey go Babilon as slave, I go bring dem kom back. Yes! I go break Babilon king pawa. Mi, wey bi God, don tok.’ ”


Dis na di leta wey I rite go give di priests, profets, leaders and all di oda pipol wey Nebukadnezzar karry as prisona from Jerusalem go Babilon.


King Nebukadnezzar for Babilon kon put Zedekaya wey bi Josaya pikin, as king for Judah, instead of Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin.


Enemies don surround Judah town wey dey sout and nobody go fit enter or go outside. Dem go karry evribody for Judah go as slave.”


den e karry am go where pipol for dey do business kon plant am for der.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka