Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 23:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all. Mi, wey bi God don tok.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 23:32
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

En profets sturbon and dem dey lie; dey tok only wetin go give dem money. En priests nor gri obey God kommand, so dem don spoil and make di temple dirty with di bad tins wey dem dey do.


Yor profets dey lie for yu kon sey dem si vishon. Na dem make una go Babilon, bikos dem nor tell una about una sins. Instead, dem make una tink sey una nor nid to turn from una sin kom meet God.


“But make una si una life! Una dey bilive lie-lie words wey nor go save una.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”


“Send message go give all di prisonas for Babilon about Shemaya. Mi wey bi God, go ponish Shemaya and all en shidren-shidren. I nor send am, but e tok to una as if en na profet and e make una bilive di lie wey e tell una.


“I know evritin wey doz profets tok; dem dey lie with my name sey I tok to dem thru dreams.


God wey dey mighty still tell Jerusalem pipol: “Make una nor listin to wetin doz lie-lie profets dey tell una; na yeye hope dem dey give una. Nor bi wetin I tell dem, dem dey tell una, but na wetin dem tink and like, dem dey tok.


Wiked men dey opress my pipol and doz wey borrow dem money, don turn to dia oga. My pipol, una leaders dey lead una anyhow and naw, una nor know di rite road wey una suppose follow.


But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.


So, wen I dey plan dis tins, I nor tink before I do am? Wen I dey plan, I dey plan bikos of wetin I wont? Or na bikos I ready to sey, “Yes, yes” or “No, no” at wons?


Yu bi oga for lie-lie; yu bi like doctor wey nor fit trit pesin wey dey sick.


Na di old pipol and rulers, bi di head, while di tail, na di profet wey dey lie waka.


God sey, “I dey si di sins wey Samaria profets dey kommit; dem dey profesai with Baal name kon lead my pipol komot from di trut.


I still dey against doz profets wey dey tok dia own word kon sey na mi tell dem.


So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?


Pipol dey go meet juju priest and doz wey dey si tumoro, but dem just dey lie and deceive dem. Some dey tok wetin dreams mean, but dem dey only deceive una and na only yuzles hope dem dey give. So many pipol dey waka anyhow like sheep wey waka lost. Dem dey trobol, bikos dem nor get who dey lead dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka