Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 23:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 So di road wey dem dey pass, go dark and go dey draw; I go make dem kick stone fall. I go bring wahala kom meet dem and di time to ponish dem, don near. Mi, wey bi God, don tok.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 23:12
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.


I don choose di time wen I go bring dis wahala kom meet Anatot pipol and wen dat time rish, nobody among dem go survive.”


But wiked pipol road dark well-well; dem go fall and dem nor go si wetin make dem fall.


Make Yu make dia way dark and make groun draw dem fall, as God angel dey porshu dem,


Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.


Wen dem look groun, dem nor go si anytin escept trobol and darkness wey go make dem fear well-well and e nor go get how dem go take eskape.


True-true, God put dem for di road wey dem go for fall kon make di groun for di hill wey go distroy dem, draw dem fall.


Naw make yu dey go; karry di pipol go di place wey I bin tell yu! Si, my angel go lead yu. Wen di day rish wen I go judge each pesin akordin to wetin e do, den I go ponish evribody for dia sin.”


Dem bi like wave for sea wey dey foam kom out. Dem bi like star wey nor dey stay one place and God don keep di place wey deep pass for darkness, dey wait dem.


But di one wey hate en broda or sista for Christ, dey for darkness and e nor know where e dey go, bikos darkness don blind en eye.


Even di pesin wey good pass among dem, bi like shuku-shuku; di one wey dey fear God pass among dem, wiked pass many shuku-shuku wey dem tie togeda. But di day wen God go judge dem, dey kom; di time wey E go ponish dem for evritin.


Make una kill all dia sojas anyhow! Babilon pipol own don finish, bikos di time don rish wen I must ponish dem.


God still sey, “Anybody wey try eskape di wahala go fall enter di pit and anybody wey fit kom out from di pit go enter trap, bikos God don set di time wey dem go distroy and skata Moab.


Dem go porshu dem from where pipol stay kon still porshu dem from lite enter darkness.


I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”


But doz wey dey opress oda pipol, nor know anytin at-all. Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness, while all di foundashon for di eart dey skata.


Si, Oga God! Why Yu dey ponish us like dis? Make wimen chop dia shidren wey dem love? Or make dem kill priests and profets for inside God temple, bikos of sofa?


Dem dey shame sey dem do dis kind wiked tins? ‘No!’ Dem nor dey shame at-all; dem nor even sabi form sef! Bikos of dis, just as pipol wey don die, na so too dem go die finish afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka