Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 22:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 I go force yu and yor mama wey born yu, go anoda kountry. Una go-go kountry where dem nor for born una and una go die for der.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 22:26
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E karry King Jehoiashin from Jerusalem go Babilon, with di king mama, en wifes, priests and all di top ofisas for di land.


Yu dey feel sey yu dey important, but God go pick yu trowey for bush.


Jehoiashin na eighteen year wen e start to rule and e rule from Jerusalem for three monts. En mama na Nehushta and na Elnatan wey kom from Jerusalem, born am.


God sey, “I go trow una komot for dis land. Yes! I go kill all of una finish.”


God tell mi, “Make yu go tell di king and en mama sey, make dem komot for di throne, bikos dia fine crown don fall komot for dia head.


So, I go drive una komot from dis land go where una and una grand-grand papa nor know at-all; land where una go dey woship oda gods both for day time and for nite, bikos I nor go sorry for una.” ’ ”


Yu go like to kom back to dis kountry, but yu nor go ever kom back again.”


Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and all Judah pipol wey go Babilon as slave, I go bring dem kom back. Yes! I go break Babilon king pawa. Mi, wey bi God, don tok.’ ”


I rite am afta dem don karry King Jehoiashin, en mama, di ofisas for di palis, Judah and Jerusalem leaders and doz wey know work well-well, go Babilon.


Judah pipol wey kom stay Egypt, nobody among dem go eskape or survive. Nobody among dem go-go back to Judah, wey dem like to go stay again. Nobody go-go back, escept some slave.’ ”


For thirty-seven years wen King Jehoiashin dey for Babilon, for di twenty-sevent day for di twelft mont, for di first year wen King Evil-Merodak dey rule Babilon, e sorry for King Jehoiashin kon release am from prison.


E give King Jehoiashin new klot and King Jehoiashin kon dey chop evriday for di king tabol,


so King Evil-Merodak dey give Jehoiashin evritin wey e wont until Jehoiashin die.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka