Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 22:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 ‘Judah king wey sidan for David throne, en ofisas and all en pipol wey dey pass dis gate, make una listin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 22:2
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E go big well-well and dem go koll am God wey dey for heaven pikin and God go gi-am en papa David throne.


If una really do wetin I kommand, den David shidren-shidren go kontinue to bi king. Both dem, dia ofisas and dia pipol go kontinue to ride horse pass dis palis gate.


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


So Sodom leaders, make una listin to wetin God dey tell una. Gomorrah pipol, make una put ear for wetin God dey tish una.


So naw, make yu listin to wetin God tok. Yu sey make I stop to profesai and warn Israel pipol; make I nor prish against Isaak family, abi?


“ ‘Naw, una wey bi shepad, make una listin to wetin mi, God dey tell una.


But naw, mi wey bi God dey tell yu, King Jehoiakim sey, ‘Yor shidren and shidren-shidren nor go ever rule for David throne. Dem go trow yor dead body for under sun and kold go make am block for nite.


All of una wey I send go Babilon as prisonas, make una listin to wetin mi wey bi God dey tok.’


“God sey, ‘Judah king and Jerusalem pipol, make una listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok: I go bring wahala kom dis place and anybody wey hear about am, go fear!


God tell mi, “Make yu go tell di king and en mama sey, make dem komot for di throne, bikos dia fine crown don fall komot for dia head.


“Make yu stand for di temple gate kon shaut tok dis message: ‘Judah pipol wey dey pass thru dis gates kom woship God, make una listin! Make una hear wetin God won tok.


So, all di sturbon and wiked rulers for Jerusalem, make una listin to wetin God dey tok.


Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am.


God tell mi, “Make yu go Judah king palis kon tell am dis message:


Di Oga wey bi Israel God sey, “Make yu go tell King Zedekaya for Judah sey, ‘Mi, wey bi God, go give dis town to Babilon king and e go burn am rish groun.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka