But naw, mi wey bi God dey tell yu, King Jehoiakim sey, ‘Yor shidren and shidren-shidren nor go ever rule for David throne. Dem go trow yor dead body for under sun and kold go make am block for nite.
“ ‘Mi, wey bi God sey, “I go ponish dem for four difren ways: I go make dem die for war. I go allow dog karry dia dead body. I go allow birds and wiked animals chop dia flesh
“ ‘ “Bikos of dis, I go skata yor throne kon kill all yor sons and shidren-shidren; both di ones wey don old and di yong ones. I go finish yor family; dem go swip dem komot like dirty.
If pesin get hundred shidren and e stay for dis life kon old, but if e nor get happiness and dem nor do betta beri for am, den I go sey, “Pikin wey dem just born and e die, betta pass am.”
Den, put dem under sun, moon and stars. Bikos dis na di tins wey dem love; tins wey dem dey woship, serve and koll make e kom guide dem. Nobody go gada dis pipol bones go beri again; so dem go bi like manure wey dem pour for groun.