Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 22:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 So, dis na wetin God tok about Josaya pikin, King Jehoiakim for Judah: ‘Nobody go mourn wen e die or tell en neighbour, “My friend, di king deat dey vex and pain mi!” Nobody go kry for am sey, “My oga and my king don die!” ’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 22:18
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Rish and poor pipol go die for dis land and nobody go beri or mourn for dem. Pipol nor go kut dia body or shave dia hair to show sey dem dey mourn for dem.


E beri am for en own family grave, den en and en shidren mourn for am and e kon sey, “Um, my broda, my broda!”


“Judah pipol, make una nor kry and mourn for di king wey dem kill. But make una kry well-well for di one wey dem go karry go Babilon, bikos e nor go kom back to di land where dem for born am again.”


Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.


yu go die for peace. Just as pipol burn incense wen dem beri yor grand-grand papa wey bi king before yu, na so too dem go burn incense for yu. Dem go mourn for yu kon sey, “Awa king don die!” Mi, wey bi God, don tok.’ ”


Profet Jeremaya sing one song for King Josaya and e don turn tradishon for doz wey dey sing for Israel and na both man and woman dey use di song wen dem dey mourn. Dem add di song join di oda mourning songs.


Jonatan my broda, si as I dey kry for yu! I love yu with all my heart, bikos di love wey yu get for mi, deep pass di one wey dem dey love woman.


E remove Asherah juju pole from God Temple kon burn am outside Jerusalem for Kidron Valley. E burn am to ashes kon trow am put for where dem for dey beri pipol.


Jehoiakim na twenty-five years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for eleven years. En mama na Zebidah wey bi Pedaaya from Rumah pikin.


E die and en pikin, Jehoiashin kon take-ova as king.


Jehoiakim na twenty-five years wen dem make am king and e rule eleven years from Jerusalem. E do wiked and bad tins before God.


E go die as slave for di kountry where dem dey karry am go and e nor go si dis land again.”


Josaya sons na: Johanan, Jehoiakim, Zedekaya and Shallum.


God sey make I tell David shidren-shidren wey dey di royal house for Judah sey,


But naw, mi wey bi God dey tell yu, King Jehoiakim sey, ‘Yor shidren and shidren-shidren nor go ever rule for David throne. Dem go trow yor dead body for under sun and kold go make am block for nite.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka