“Yu si as pipol dey sey I don rijet Israel and Judah pipol; di two family wey I choose? Na dis make dem nor dey respet my pipol at-all, bikos dem nor si dem as strong nashon again.
“God sey, ‘Judah king and Jerusalem pipol, make una listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok: I go bring wahala kom dis place and anybody wey hear about am, go fear!
“Make yu stand for di temple gate kon shaut tok dis message: ‘Judah pipol wey dey pass thru dis gates kom woship God, make una listin! Make una hear wetin God won tok.
Dat time, Israel pipol dey holy to di Oga God; na dem bi di first fruit wey E plok and evribody wey won attack Israel, God dey ponish and distroy dem.” ’ ”