Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 2:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Israel pipol, make una nor let una shoe skata or allow una troat dry as una dey run follow oda gods. But una sey, “No! Wi nor go fit go back. Wi love dis gods and wi go follow dem.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 2:25
27 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dem make am jealous, bikos dem dey serve juju and oda gods.


But dem go sey, ‘No! Wetin go make us shange? Wi go do anytin wey wi wont! Awa heart strong and wi go do all di wiked tins wey wi wont.’ ”


But make una first gri sey una don sin against mi wey bi di Oga una God. Make una konfess sey una nor dey obey my kommand and una don show una love to oda gods for under evry green tree.” Mi, wey bi God, don tok.


Na dis hope save us. But if wi don already get wetin wi dey hope for, den wi nor nid to dey hope again. Abi who dey hope for wetin e don already get?


Dia shidren tongue don gum, bikos dem nor si wota drink; dem dey beg waka, but nobody gri give dem food chop.


God tok about dis pipol sey: “Dem dey run from mi and dem nor dey kontrol demsef. So, I nor dey happy with dem. I go remember all di bad-bad tins wey dem don do kon ponish dem, bikos of dia sin.”


And wen una ask, “Wetin make all dis tins dey happen to us? Why dem tear awa klot komot from awa body kon trit us like ashawo? Na bikos of sin?” Yes! Na bikos una don sin.


Naw, make una si as una dey work hard to find oda gods and yet e nor dey taya una. Una tink sey na bikos una juju dey give una pawa, na-im make una nor dey taya to work?


My God, Yu don forget yor pipol wey bi Jakob shidren-shidren, bikos dem dey do majik for evriwhere for di land; dem dey go meet majik pipol just as Filistia pipol dey do and na strenjas bi dia friends naw.


Na wen King Ahaz dey for trobol, e even disobey God pass.


una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.


Naim e shaut, ‘Papa Abraham, make yu sorry for mi, abeg send Lazarus make e put en finger for wota kon tosh my mout, bikos I dey sofa inside dis fire.’


“But di papa koll en savants kon tell dem, ‘Make una bring di best klot, ring and shoe and make una wear dem for my pikin.


If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.


Instead, wi go do evritin wey won do. Wi go offa sakrifice give awa goddes wey bi Heaven Kween kon pour wine for am too, just as wi, awa grand-grand papa, awa king and leaders dey do for Judah towns and Jerusalem strits before. Dat time, wi get plenty food to chop; wi dey prosper and wi nor get wahala.


Pipol for dis generashon! Make una listin to wetin God dey tok: “Israel pipol, I bi like desert for una eye naw? Abi, I bi like land wey dark well-well? So wetin make my pipol dey sey, ‘Wi don free from God hand and wi nor nid am again!’


Wetin una go tok wen di pipol wey una bin tink sey bi una friends katch, distroy and kon dey rule una? E go pain una like woman wey won born?


Jerusalem pipol, make una shaut and mourn as una dey go Lebanon. Make una kry go Bashan land; make una shaut well-well for Moab mountins, bikos dem don distroy una propaty.


Jerusalem pipol dey kry well-well for nite. Doz wey love am nor dey again to konfort am and all en friends don lie for en head; dem don turn en enemy.


“Una gri sey una won bi like di oda kountries; like pipol for oda kountry wey dey woship three and mountin. But una plan nor go work.


Dia mama sey, “I go-go meet my lovers, bikos na dem dey give mi food, wota, wool, linen, olive oil and wine.”


Una sey, ‘E nor get wetin pesin go gain if e serve God. Wetin bi di nid to do wetin E tok or try to show Oga God sey wi dey sorry for wetin wi do?’


E sakrifice give Damaskus juju, bikos e tink sey na di juju win am. E tok for en mind sey, “Bikos Damaskus juju help en pipol, I go sakrifice gi-am, so dat e go kom help mi too.” But dis won kon make Assyria sojas distroy en and evribody for Judah.


Wen una dey prosper and enjoy, God tok to una, but una nor gri listin. Na so una dey bihave since and una nor gri obey God.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka