Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 18:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Na evil dem dey take pay good? Naw, dem don dig pit for mi make I fall inside. Wen Yu dey vex dat time, make Yu remember as I beg Yu bikos of dem, so dat Yu nor go ponish dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 18:20
31 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My enemies don set trap for mi and I don taya bikos of dia wahala. Dem dig deep pit for where I dey waka pass, but na dem go fall enter by demsef.


bikos I nor do dem any bad tin, but dem dey set trap and dig pit to katch mi.


So God kon sey E go distroy dem. But Moses, wey E choose kon stand between God and di pipol. E beg make God nor vex distroy dem.


Dem dey pay mi bad for di good wey I do and dia wahala dey make mi sick.


Make tif karry evritin wey dem get for dia house, so dat dem go kry well-well. Bikos dem don dig whole make I fall put kon set trap make e katch mi.


Anybody wey dig pit for odas, go fall enter by ensef and pesin wey break wall pass, snake go bite am.


So, anybody wey dig pit for pesin go fall inside my ensef and pesin wey roll stone to wound odas, na di stone go fall kill-am.


Even doh wiked pipol dey hide for road to kill mi, I kwayet as I keep yor laws for my mind.


All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’


So Jesus tell dem, “I don do many good tins wey una si from my Papa, wish one make una won stone mi so?”


Wi don sin against Yu wey bi God; so wi dey konfess awa sins and di ones wey awa grand-grand papa dem kommit.


So, Jeremaya my profet! Make yu nor pray or beg mi bikos of dis pipol. Wen dem dey trobol, make dem nor koll mi for help, bikos I nor go listin to dem.”


Den God tell mi, “Jeremaya! Make yu nor pray for dis pipol. Make yu nor kry or pray give mi bikos of dem! Nor beg make I save dem, bikos I nor go listin to yu.


If yu use bad take pay good, den bad tin nor go ever komot from yor house.


Dem dey pay mi bad for good kon dey oppoz mi for di good tins wey I do.


E dey dig deep pit for odas, but na en ensef dey fall enter


Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.


So Jonatan tok to en papa about David, “Make di king nor sin against en savant David, bikos e neva sin against di king. To tink am sef, David don really help di king.


Wiked men dey stay among my pipol, dem dey wait like pipol wey dey spread net to katch bird or set trap to katch pipol.


Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!


So, I kon pray: “My God, make Yu hear and listin to wetin my enemies dey tok about mi.


If dem really bi profet or get my message, make dem pray give mi, di God wey dey mighty sey, “Make Yu nor allow dem karry all di betta-betta tins wey remain for di temple and palis, go Babilon.


Yu don si di bad-bad tins wey dem do mi. So my God, make Yu judge my kase, so dat pipol go know sey I dey rite.


Pipol wey dey tok bad against mi, make Yu disgrace dem kon save mi. Make fear katch dem, but nor make mi dey fear. Distroy and break dem into pieces.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka