How I wish dem know wetin I dey tink for my mind, den dem for fit prish my message give my pipol, so dat dem go stop di kind life wey dem dey live and di bad-bad tins wey dem dey do.
For dat time, God tok to Isaya wey bi Amos pikin sey, “Make yu remove di sak wey yu wear and di sandal wey dey yor leg.” So e obey God kon waka naked without sandal for leg too.