Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 17:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 or bring anytin kom out from una house or do any work. But make una si am as holy day for God, just as I kommand and tell una grand-grand papa dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 17:22
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I still give dem my Sabat wey go show my promise with dem, so dat dem go remember sey na mi make dem dey holy.


God sey, “If una keep di Sabat Day holy and una nor run follow wetin una wont dat day; if una value my holy day and honor am and una nor travel, work or tok yeye word for dat day,


“Una go work for six days, but make una nor work for di sevent day, so dat una melu, donkey, slave and strenjas wey dey work for una, go rest.


On Sunday, God Spirit kon dey kontrol mi and from my back, I kon hear one loud vois like trumpet dey sey,


Den di wimen go house go prepare betta perfume. But for Sabat Day, dem kon rest as Moses Law tok.


So Jesus tell dem, “Na Man Pikin bi Sabat Day Oga God.”


Una nor dey respet di holy place or keep di Sabat holy.


“ ‘Una go work for six days, but di sevent day, na di day wey una suppose rest. For dat day, una nor go work, but una go gada woship God.


Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.


For dat time, I si pipol for Judah dey make juice from grapes for Sabat Day. While some dey load korn, wine, grapes, figs and oda tins on-top dia donkey kon take dem go Jerusalem. So I warn dem sey make dem nor sell anytin for Sabat Day.


“God still sey, ‘Una must obey all wetin I kommand. Una must nor karry load pass di town gates for Sabat Day. Una must si Sabat as holy day and una nor go do any work for dat day.


Make una nor bi like una grand-grand papa dem. Before-before, my profets prish give dem sey, make dem stop to sin and do evil, but dem nor gri listin or obey dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka