God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.
Naw, my Oga God, make Yu kom save us! Make Yu gada us back from evriwhere wey wi skata go, so dat wi go tank yor holy name kon happy as wi dey praiz Yu.
“God Spirit dey my body, bikos E don anoint mi make I prish Good News give poor pipol. E send mi make I prish freedom give pipol wey dey prison and make blind pipol for si. E still sey make I free doz wey dem dey opress
I hear Israel pipol dey tok with pain sey, “Oga God! Wi bi like animal wey dem nor train, but Yu don tish us to dey obey. So make Yu bring us kom back, bikos wi dey ready to kom meet Yu di Oga wey bi awa God.
Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”