Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 17:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 17:13
40 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Bikos di Lamb for di throne, go bi dia Shepad. E go take dem go drink from di river wey dey give life. And evry tears wey dey dia eyes, God go klean am komot.”


Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne.


But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”


Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”


E still tell mi, “God don do am finish! Na mi bi di Alfa and Omega, di startin and di ending. Anybody wey dey hongry for wota, I go gi-am wota wey dey give life and e nor go pay.


But E go kill anybody wey dey sin and fight against am. E go kill anybody wey nor respet am.


Make una nor only dey happy sey evil spirit dey obey una, instead make una happy sey God rite una name for heaven.”


Yet, na Yu bi di only hope wey Israel get; na Yu save us from wahala. So naw, why Yu kon bi like strenja for awa land or like pesin wey dey travel kon branch stay for one nite?


Anybody wey dem nor si en name inside di Life Book, dem go trowey am inside di big fire.


Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.


So doz wey nor dey fear am go die, bikos E dey distroy doz wey turn from am.


bikos my pipol don kommit two difren sin against mi: dem don leave mi wey bi di spring wey dey give dem fresh wota and dem dig one well for diasef wey nor fit keep and gada wota.


God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois dey make nois from Jerusalem and di eart with di sky kon dey shake. But God go defend and protet en pipol.


But na Israel pipol kause all dis tins, bikos dem leave di Oga wey bi dia God, even wen E dey show dem di korrect road.


Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.


Paul wey bi Jesus Christ apostle thru God awa Savior kommand, na-im rite dis leta and na Jesus Christ bi di hope wey wi get:


Bikos of dis, I kon sey I won si and follow una tok first sey, na bikos of di hope wey Israel get, naim make dem use dis shain tie my hand so.”


Many pipol wey don die go raiz; doz wey dey holy go get life wey nor dey end, while odas go sofa forever.


Israel pipol, I wont make una know sey I nor dey do all dis tins bikos of una. So make una shame and hide una face bikos of all di bad tins wey una don do. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


I go forgive yu all di bad tins wey yu don do, but wen yu remember dem, shame nor go let yu open yor mout.” God wey get pawa don tok.


Nor make mi fear Yu, bikos na Yu dey save mi wen I dey trobol.


God sey, “I go curse di pipol wey leave mi kon go trust human being. Pipol wey depend on flesh and blood for dia pawa.


Just as doz wey dey judge odas dey get wetin dem deserve; na so too good pipol dey get dia reward.


Pipol go remember good pesin bikos of di good tins wey e do, but dem go soon forget wiked pesin forever.


But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.


Awa grand-grand papa dem trust Yu and Yu save dem.


bikos na only Yu bi my hope and na from wen I bi small pikin, I don dey trust Yu kom rish naw.


Pipol wey dey tok bad against mi, make Yu disgrace dem kon save mi. Make fear katch dem, but nor make mi dey fear. Distroy and break dem into pieces.


I go do am, bikos di pipol don forget mi kon dirty dis place as dem dey sakrifice give gods wey dem or dia grand-grand papa or Judah kings nor know and dem kill innocent pipol for here too.


Evribody wey si dem, dey attack dem. Dia enemies sey, ‘Nobody go ponish us for wetin wi do dem, bikos dis pipol don sin against di Oga God wey go give dem rest and wey dia grand-grand papa trust.’


I go soon ponish una wey bi lie-lie profets, bikos wetin una dey tok, dey skata pipol. Una nor go dey der wen my pipol go gada make decision; una name nor go dey among Israel pipol and una nor go ever kom back to di land. Den una go know sey na mi bi God.


Israel pipol wey bi prisonas, make una kom back, bikos una don get hope. Make una kom back to di place where una go for dey save. I dey tell una naw sey, ‘I go give una doubol blessing, bikos of how una don sofa.’


God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.


Dem dey opress and sofa mi! So my God, make Yu diliver and protet mi!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka