Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 16:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 I go make dem pay times two for dia sin and wikedness, bikos dem don dirty my land kon pak dia yeye juju wey nor get life, full am.’ ”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 16:18
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Give Jerusalem pipol heart. Tell dem sey dem don sofa rish and God don forgive dem dia sins. Yes! I don ponish dem well-well for dia sins.


Make yu pay am as e take pay odas; pay am doubol for wetin e do. For di wine cup wey e mix, make yu mix doubol for am.


But pipol wey still like to woship juju and do bad tins, I go ponish dem. I go ponish dem for di tins wey dem don do.” God wey get pawa well-well don tok.


Pipol wey dey tok bad against mi, make Yu disgrace dem kon save mi. Make fear katch dem, but nor make mi dey fear. Distroy and break dem into pieces.


I take una go betta land, so dat una go enjoy di fruit and all di oda good tins wey dey der, but wen una rish der, una turn di land to dirty.


“Wen dem kom back, dem must skata all di rubbish tins wey dem dey do before kon skata any juju wey dem si for der.


Bikos Israel sin nor mean anytin to dem, dem kon kontinue to spoil di land as dem dey woship stones and wood.


Una shame and disgrace don end. Una go stay for una own land and una propaty go bi times two, den una joy go last forever.


So make una komot der and dis land nor dey save again, bikos una don use sin skata am finish!


Di pipol wey dey dis world, don skata am with sin, bikos dem nor gri obey God law or keep en kovenant wey go last forever.


Dem kill innocent pipol kon sakrifice dia sons and dotas give Kanaan juju, so di land kon full with innocent pipol blood.


I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.


I don already know how I go take ponish dem and dem don rite di way dem go take die for groun. I nor go look wetin dem don do kon trowey face, but I go pay dem back


God sey, “I don rijet Judah pipol, bikos of di wiked tins wey dem do. Dia juju wey I hate, dem put am for my temple kon make di temple dirty.


I dey send my savants and di profets kom meet dem, so dat dem go stop all dis wiked tins wey I hate,


“So as long as mi God dey alive and as una don spoil my temple with una juju and all di bad tins wey una dey do, I nor go sorry for una wen I dey distroy una.


Di time to ponish Israel don rish; di time wey pipol go get wetin dem deserve. Dat time, Israel pipol go know wen e happen! Una sey, ‘Dis profet na fool. Dis man wey feel sey e know well-well, dey kraze!’ Una hate mi well-well, bikos una sin too many.


for dia sins and dia grand-grand papa own. Dem don burn incense for juju hills kon tok bad tins about mi. So I go ponish dem for wetin dem don do pass.”


Bikos of di pipol wey dem don kill for di land and juju wey dem pak full am, I kon let dem feel as my vexnashon strong rish.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka