Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 15:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 I kon sey, “Si as I dey vex! Wetin make my mama born mi at-all? Must I kworel and argue with evribody for di land! I neva ever borrow from pesin or borrow pesin money, yet evribody dey curse mi.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 15:10
32 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Una wey pipol hate, rijet, curse and dey koll bad pipol bikos of Man Pikin, God go bless una


“If una borrow money give poor pipol wey dey among una, make una nor do like sey una borrow money and make una nor add join di money wen dem won pay back.


Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept.


“Dem go karry una wey bi my disciples give pipol wey go sofa and kill una. Bikos of mi, pipol for difren town wey nor know God, go hate una.


But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’,


Bikos of dem, I go make yu bi like strong wall. Dem go fight yu, but dem nor go fit win. I dey with yu; I go protet and save yu.


Just as bird dey fly pass, na so too, curse wey dem put for yor head and yu nor deserve am, nor go do yu anytin.


Make dem curse mi if dem like, bikos I know sey Yu go bless mi! Wen dem attack mi, na disgrace go follow dem! But mi, yor savant go always dey happy!


Some pipol dey borrow money give odas without intrest and dem nor dey kollect bribe to lie for pesin head. Di pipol wey dey do dis kind tins, go stand gidigba forever.


King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”


Wen King Ahab si Elijah, e kon sey, “My enemy, yu don find mi si abi?” Elijah ansa, “Yes! I don find yu si. Yu don do wetin nor dey good at-all for God eye.


Make una nor add intrest join, but make una obey God, so dat una fellow Israel pipol go fit stay near una.


But wi go like to hear wetin yu dey tish from yor own mout, bikos wi know sey evribody for di whole world dey take mout kondemn dis group wey yu dey inside.”


Make una nor add intrest for di money wey una borrow dem or gain for di food wey una sell give dem.


Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!


Why Yu allow mi dey face dis kind trobol? Must I si all dis wahala wey dey happen to mi? Anywhere wey I look, na only wahala and distroshon I dey si. Na pipol wey love to kworel and fight, dey round mi.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka