Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 14:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Make Yu remember yor promise and nor hate us. Nor disgrace Jerusalem, di place wey yor throne wey get glory, dey. Abeg, make Yu nor break di kovenant wey Yu make with us.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 14:21
39 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.


E remember en kovenant with dem kon sorry for dem, bikos of en love wey nor dey fail.


Wen dat time rish, pipol go know Jerusalem as ‘God Throne’ and all di nashons go gada kom woship mi for der. Dem nor go do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do again.


So I sey, “My God, na from di biginnin Yu sidan for yor throne wey get glory. Na only Yu bi di Pesin wey go fit save us.


But nor measure di temple varanda, bikos God don gi-am to Gentile pipol and dem go mash am for forty-two monts.”


E do dis, to show evribody for di world wey dey kom sey, en grace wey dey show us kindness thru Jesus Christ, big well-well.


Dem go use swod kill some, karry some as prisona go anoda kountry and di Gentile pipol go distroy Jerusalem, until di time wey God sey Israel must sofa, go end.


E do dis tins to show en love for awa grand-grand papa dem and to remember di promise wey E give dem.


Oga God wey get pawa don warn una well-well sey, “I hate as Israel pipol proud rish; I hate di strong and big-big house wey dem get. I go give dia main town and evritin wey dey inside, to dia enemies.


“Awa God! Na only Yu dey do wetin dey rite, but dem dey disgrace us evriday, bikos Judah, Jerusalem and all di pipol wey Yu skata go evriwhere, nor gri listin to Yu.


“Man pikin, na my throne bi dis. I go stay here with Israel pipol kon rule dem forever. Di pipol for Israel or dia kings nor go disgrace my name wey dey holy again or woship anoda god or dia king wey don die.


God wey get pawa sey, “But naw, I go sorry for Jakob shidren wey bi Israel pipol kon make dem prosper again. Yes! I go guide my holy name.


I tell Israel pipol dis message: ‘Una dey happy, bikos of una temple. Una like to dey look and go der, but I go distroy am and di small-small pipol wey una get for Jerusalem go die for war.’


Si, Oga God! Why Yu dey ponish us like dis? Make wimen chop dia shidren wey dem love? Or make dem kill priests and profets for inside God temple, bikos of sofa?


Dem don tif all wetin e get; all en betta tins don vanish. E dey look as strenjas dey use di holy temple anyhow; di place wey God sey make dem nor enter.


Den I sey, “My God, Yu don forget Judah pipol? Na so Yu hate Zion town? Wetin make Yu dey do us like dis, sotey wi nor dey okay again? Wi dey hope for peace, but na wahala wi dey si. Wi dey bilive sey wi go well, instead na trobol dey follow us.


and na dis make God leave en pipol wey bi en special propaty.


Nor drive mi komot from yor present or take yor holy spirit from mi.


So wen God si all dis tins, E vex bikos en shidren dey disobey am.


I go stay with una for inside my holy tent and I nor go ever komot for where una dey.


Make Yu remember Abraham, Isaak and Israel yor savants wey Yu promise sey, ‘I go make una shidren-shidren plenty like di stars for sky and all dis land wey I don tok about, I go give dem to una shidren-shidren and dem go stay der forever.’ ”


God nor go leave en pipol, bikos E don make promise with una grand-grand papa. God happy to make una en own pipol.


My God, bikos of di honor wey yor name get, make Yu forgive mi my many-many sins.


Dem go tok about di glory wey dey yor kingdom; dem go tell pipol about yor pawa.


Jerusalem pipol, I go put pipol wey go dey guide una walls and dem nor go kwayet both for day and nite. But una wey dey pray give God, make una nor stop at-all.


but I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka