Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 14:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 “Judah dey mourn and en pipol dey die anyhow; en pipol sleep for groun dey kry. Yes, Jerusalem pipol dey kry for help.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 14:2
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den Zion pipol go sidan for groun dey kry and mourn, bikos of dia pipol wey die.


My heart dey feel pain, bikos my pipol heart heavy; I dey kry well-well and fear dey katch mi.


Doz wey nor die, get sore full body and di kry wey di town pipol dey kry, dey even rish heaven.


“Bikos dem nor gri listin wen I tok to dem, na so too I nor go listin anytime wey dem pray to mi.


So, mi wey bi God sey: ‘I go soon distroy dem and dem nor go fit eskape. I nor go listin to dem wen dem kry kom meet mi for help.’


Evribody dey fear and kry as dem si dem dey kom.


Di farm don empty; di groun dey mourn, bikos dem don distroy all di korn. All di grapes and di olive trees don dry.


So di land go mourn, bikos evritin wey dey inside, go die. All di animals, birds and even fish, go die too.”


Awa skin hot like oven and na honga make us dey sick so.


Di town gates don sink enter groun. E skata all di keys and bars wey dem take dey lock di gates. Dem take en prince dem and kings go Babilon as slave. Law nor dey again and God profets nor dey get any vishon from am again.


Make tif karry evritin wey dem get for dia house, so dat dem go kry well-well. Bikos dem don dig whole make I fall put kon set trap make e katch mi.


Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”


Bikos of dis, di eart go kry and di sky go black, bikos God don tok sey na so e go bi and E nor go shange en mind.”


Di land don dry and nor-tin dey inside again. Lebanon forest don dry finish; Sharon valley bi like desert naw and di trees for Bashan and Karmel mountin don dry finish.


Di new grape vine don dry and wine nor dey again. All di pipol wey dey happy before, don dey vex naw


Di eart don dry, di whole world dey shake like pesin wey kold dey katch and e don dry too; pipol wey dey popula for dis world, don die go.


My heart dey kry for Moab pipol, bikos di pipol don run go Zoar, Eglat and Shelishiyah town. Some even dey kry as dem dey go Luhit, while odas eskape go Horonaim town.


Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.


Dem make poor pipol dey kry to God and E don hear dia koll for help.


“For dis time tumoro, I go send one yong man kom meet yu from Benjamin tribe. Yu go anoint am kon make am king ova my pipol, Israel. E go save dem from Filistia pipol hand. Bikos I don favor my pipol and dia prayers don rish my ear.”


God hear dia kry and E remember en kovenant wey E make with Abraham, Isaak and Jakob.


Make awa melu karry many propaty as dem dey kom. Make no enemy break enter awa wall kon katch us and make peace dey awa town.


Dem dey shaut for dia street, bikos of wetin happen to dia wine. Happiness don komot di land forever and na sorrow full der naw.


Dem don turn am to wildaness. Di land empty and dey yuzles to mi. Di whole land don turn desert and e nor koncern anybody.


Oda nashons don hear of una shame and evribody don hear una kry. One soja fall press anoda one and unasef don fall rish groun.


God won distroy Jerusalem fine wall. E dey plan to distroy am and E go do wetin E plan. Den E go skata di towas and di walls rish groun.


Yes, I don sey rain nor go fall for una land, hills, farm, vineyard, olive trees and for evritin wey di groun dey produce for una and una animals. I go skata evritin wey una dey work hard to get.”


Una wey bi farmer and doz wey dey kare for di vineyards, make una kry, bikos of una rice and sweet korn. Yes! All wetin wi plant don skata.


Koll and tell evribody sey make dem fast! Gada di leaders and all Judah pipol go meet and kry give God for en temple!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka