Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 13:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Jerusalem pipol! I don si as una dey do ashawo waka and as una dey run follow difren juju for fields and for evry hill. Naw, make una si di wahala wey dey wait una. So, una go ever dey klean to woship mi again?

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 13:27
32 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I hate di gold melu wey Samaria pipol dey woship. I dey vex well-well for dem. Na wen dem go stop to woship juju?


Jerusalem pipol! Una yeye life don make una dirty, even doh I try make una dey klean, una still dirty. Una nor go dey klean again until my vexnashon don fall on-top una with full force.


Dead body go skata round dia juju and en altars; both for dia hill and on-top evry mountin, under evry green tree and evry oak tree and for evriwhere wey dem for dey burnt sakrifice give dia juju. Dat time, evribody go know sey na mi bi God.


for dia sins and dia grand-grand papa own. Dem don burn incense for juju hills kon tok bad tins about mi. So I go ponish dem for wetin dem don do pass.”


Dem nor dey keep di promise wey dem make. Instead, dem dey lie, kill, tif and sleep with oda pipol husband and wife. Na so-so wiked tins dem dey do and dem dey kill each oda evriday.


God wey get pawa sey, “I go allow Israel pipol ask mi for help and dem go plenty like sheep again.


Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?


Den I look and I hear one eagle dey shaut as e dey fly for sky, “E go bad well-well! E go bad well-well! E go bad well-well for pipol wey dey dis eart, bikos of wetin go happen wen di last three angels go blow dia trumpets.”


Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.


I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.


So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.


“E nor go betta for Korazin and Betsaida pipol! If to sey di mirakles wey dem do among una happen for Tyre and Sidon, dem for don turn from dia sin kom meet God, kon karry ashes put for head and wear tear-tear klot,


Bad tins go happen to Jerusalem pipol, bikos dem don spoil di town kon turn am to where wayo full.


Wen God first tok to Israel pipol thru Hosea, E tell am, “Make yu go marry ashawo and just as my pipol don leave mi and nor dey faithful to mi, na so too yor wife nor go dey faithful to yu and e go born shidren wey nor go know dia papa.”


I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.


Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Di town where dem for dey kill pipol, curse dey una head! E bi like dirty pot wey dem nor fit wosh klean. Dem dey remove di meat one-by-one and nor-tin remain inside.


I bring dem kom di land wey I don promise sey I go give dem. Wen dem si how di tree for der fine and how di mountin tall rish, dem kon bigin sakrifice give di tree and mountins. Dem make mi vex, bikos of di sakrifice wey dem dey burn and di wine wey dem dey offa as ofrin.


Di hand open di book and dem rite put for di two side. Na kry, mourning and pains dem rite put for di book.


Una dey go di mountins wey high pass go sakrifice and sleep with one anoda.


How long dem go dey tok anyhow? Na how long dis wiked pipol go dey make mout?


Wen King Josaya dey rule for Judah, God tell mi sey, “Israel pipol wey nor dey faithful, yu si all wetin dem dey do? Dem don waka leave mi kon dey do ashawo for under evry green tree and high hill.


But una wey bi fool, make una tink again! Wen una go really get sense to undastand?


God tell Judah pipol, “Di pipol wey I love dey do wiked tins, so wish rite una get wey make una dey kom my temple? Una tink sey una fit offa sakrifice to stop all di bad tins wey una don do? Una dey happy to do wiked tins even wen una dey offa di sakrifice.


God sey, “Si di kind sofa wey dey wait yu bikos of yor many evil and as


But all dis yeye tins nor go vanish komot like dat.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka